How dem stab rapper Tory Lanez 14 times inside prison

Tory Lanez wit band on im head, e open im mouth and eyes

Wia dis foto come from, Getty Images

  • Author, Christal Hayes
  • Role, BBC News, Los Angeles

Dem stab Canadian rapper Tory Lanez 14 times for inside prison for California and dem don rush am go hospital.

Di Canadian hip-hop artist chop attack from anoda inmate wey dey inside di same prison.

DI incident happun for Monday morning for di housing unit for di California Correctional Institution insie Tehachapi wey dey about 75 miles (120km) north of Los Angeles, according to wetin prison officials tell BBC.

Di 32-year-old rapper suffer serious wounds across im body wey cause both of im lungs to collapse, according to a post wey dey for im Instagram account.

Lanez wey im legal name na Daystar Peterson, dey serve a 10-year prison sentence for shooting im fellow musician Megan Thee Stallion for 2020.

Rapper Tory Lanez hold a microphone for event. E get multiple diamond chains, rings and a silver diamond bracelet.

Wia dis foto come from, Getty Images

How dem stab am

Di star Instagram post say dem stab am for back, torso, head and face. Dem temporarily place am on a breathing apparatus but e later dey able to breathe on im own, di Instagram post say.

“Despite say e dey in pain, e dey tok normally, in good spirits, and deeply dey thankful to God say e dey pull through,” di post say.

Di attack happun around 07:20 local time (15:20 GMT), according to Pedro Calderón Michel from di state corrections department.

Prison staff begin first aid bifor dem take Lanez to a local medical facility for further treatment, e tok.

Investigation dey go on into di stabbing, Mr Calderón Michel tell BBC. E no comment on wetin make di inmate attack am.

Mugshot of rapper Tory Lanez

Wia dis foto come from, California Department of Corrections and Rehabilitation

Skip Instagram post

Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Wetin lead Tory Lanez to prison

Lanez chop sentence for 2023 for three felony gun-related charges wey include assault wit a semi-automatic firearm.

Di rapper chop 10 years imprisonment for di shooting of Grammy winner Megan Thee Stallion for leg during one argument between dem wen dem dey comot from one pool party for reality star Kylie Jenner Hollywood mansion for 2020.

Dem find am guilty on three gun-related charges for December and don keep am for jail since den.

Prosecutors bin ask di judge to impose a 13-year prison sentence.

Dem say Lanez deserve a long sentence for shooting a “vulnerable victim” on a quiet residential street, and for waging “a campaign to humiliate and re-traumatise her” afta di attack.

Meanwhile, after di shooting, make Megan Thee Stallion need to do surgery to remove bullet fragments from her leg.

Dat time, LA District Attorney afta di verdict say, di fact say she dey popular help to bring attention to di issue of violence against women.

DI two of dem bin first argue inside vehicle about dia previous sexual relationship and careers, Megan Thee Stallion bin testify during di trial.

She say she demand say make dem leave am out of di vehicle wey make Lanez start to dey shoot for ground and begin shout at her say make she “dance”.

Lanez bin refuse to apologise and e maintain say im dey innocent for di shooting.

Di case bin divide di hip-hop world wit rappers wey include 50 Cent and Iggy Azalea beginning to take sides inside di rofor-rofor wey hit di music industry.

Some of dem even write to di court to ask say make dem pity Lanez for di sentencing.

Lanez get seven US top 10 albums for di seven years bifor im conviction.

This post was originally published on this site be sure to check out more of their content.